Check out the Latest Naija Gist from Nigeria, Nigerian Celebrity Gossip, Photos, Man - wife snatcher, husband snatcher, Facebook updates of Celebrities, Blog post, Nigerian Police,Celebrity's baby, Share on Facebook, Married actresses, Nigerian, Blog photo, ọmọ oódua Networking, News Art, Entertainment Forum and Nigerian Gist with Yoruba Culture and Tradition.
Akpos was asked to complete the following: 1)He who fights n run away? Akpos:e donsurrender be dat na, na fear catch am. 2)A rolling stone? Akpos: No fit just dey roll,na person push am. 3) He who lives in a glass house? Akpos:Na richpolitician e go be. 4)A stitch in time? Akpos:dey prevent further tear tear. 5)Birds of d same feather? Akpos: Na d same mama born them. 6) One good turn? Akpos: Na correct power steering fit do am. 7) A bird in hand? Akpos: Wetin e wan be again if no be barbeque. Dem plenty for chicken republic. Half bread is better than? Akpos: Puff puff, buns or garri without sugar. 9) A journey of a thousand miles? Akpos:Na d person wahala be dat na, Why e no enter car or aeroplane jeje?
10) He who laughs last? Akpos: Get brain problem.Make dem examine am becos na begining of madness be dat. 11) A patient dog? Akpos: Na hunger go kill am. 12) All work and no play? Akpos: Na bank job be dat bros. Hit like,comment and share..
No comments:
Post a Comment